Naija wahala dey make Kanu Nwankwo dey shake hin head

Naija wahala dey make Kanu Nwankwo dey shake hin head

- Former Naija striker Kanu Nwankwo no dey happy with the wahala wey dey happen for Naija football

- Kanu talk say na everyday na hin the matter dey pain am for body sake of say Naija no gree qualify for the Nations Cup

- Hin also add join hin tori say all the kasala wey dey happen for Naija football go soon kpafuka

Kanu Nwankwo wey be one time skippo for the Naija Super Eagus don talk say the katakata wey dey happen for the Naija football no dey allow am sleep well well.

The guyman yarn say the kasala wey dey worry am pass for the matter na hin be how Naija no fit qualify for two Nations Cup plus how the Naija small pikin teams (U 20, U 17,) no fit make am for too.

Naija wahala dey make Kanu Nwankwo dey shake hin head
Nwankwo Kanu

Nwankwo wey all man dey call am 'papilo' talk say wetin dey happen for Naija football no dey make hin belle dey sweet am at all because na every day na hin the matter dey give am headache.

“Walahi na everyday na hin I dey think this matter, and the thing too dey pain me for body because no be for Naija na hin this kind yawa suppose dey happen.

“The koko now be say make all of us tanda gidigba make we support the Naija football because no be all of us fit be coachi,” naso Kanu talk.

Even though Naija no get any thing wey dem go gain for match between Super Eagles and Tanzania, Kanu yarn say the game go be big test for the new Eagus coachi wey hin name be Gernot Rohr.

“I know say plenty Naija fans go wan see how this new coachi go take start hin work plus the kind players wey hin go use, but nothing spoil sha because our football don kolo and na must make we make kommot all the katakata wey dey for road.”

Source: Legit.ng

Online view pixel